Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,163,722 members, 7,855,052 topics. Date: Sunday, 09 June 2024 at 01:05 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61560 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)

Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:06pm On Feb 11, 2009
You be de correct sugar for my garri,
And I love you pass all girls for Warri.
You be de apple for my own eyes,
If no be you I go die frozen like ice.
You dey homely like ofada rice,
We no go fight again like cat & mice.
You be my ogbenga orishirishi for egusi soup,
Soon I go buy for you a mercedes coupe.
You be the only Christmas clothe for my wardrope,
If you leave me,walai, I go hang myself with a rope.
My endless love & African angel with you I no fit sleep,
Even my own people say you don turn me to a sheep.
At this season of Valen-wetin and always,
My bodi,heart, & pocket na for you always.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by abdulone(m): 1:05pm On Feb 12, 2009
thats great and really lovely guy[b], i like it[/b]

here is mine

i write yuor name on the sand
and the breeze blew it away

when i write on water
it got washed away

when i write it in the sky,
the night covered it

when i write it on my heart
i got heart attack
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:57pm On Feb 12, 2009
abdulone:

thats great and really lovely guy[b], i like it[/b]

here is mine

i write yuor name on the sand
and the breeze blew it away

when i write on water
it got washed away

when i write it in the sky,
the night covered it

when i write it on my heart
i got heart attack
LOL
True love surely do give lovers heart attack. Take heart. Love is pain. Love is life and death
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:36am On Feb 13, 2009
rotimy:

You be de correct sugar for my garri,
And I love you pass all girls for Warri.
You be de apple for my own eyes,
If no be you I go die frozen like ice.
You dey homely like ofada rice,
We no go fight again like cat & mice.
You be my ogbenga orishirishi for egusi soup,
Soon I go buy for you a mercedes coupe.
You be the only Christmas clothe for my wardrope,
If you leave me,walai, I go hang myself with a rope.
My endless love & African angel with you I no fit sleep,
Even my own people say you don turn me to a sheep.
At this season of Valen-wetin and always,
My bodi,heart, & pocket na for you always.

bros, abeg u try
if i be ur babe i for dyyee
'cos dis kain love fit kill
e sweet pass jack n jill
dis one dem say u turn to sheep
hope say for night u dey sleep?
no worry, if she no want u dis valentine
i get one small sister wey too fyyynnnee . . . .


u go like? grin

no mind me o, all na psyche!!!



i dig ur poem no be small sha . . .
make i tiff am for my val na . . . ?tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:03pm On Feb 13, 2009
maedan:

bros, abeg u try
if i be ur babe i for dyyee
'cos dis kain love fit kill
e sweet pass jack n jill
dis one dem say u turn to sheep
hope say for night u dey sleep?
no worry, if she no want u dis valentine
i get one small sister wey too fyyynnnee . . . .


u go like? grin

no mind me o, all na psyche!!!



i dig ur poem no be small sha . . .
make i tiff am for my val na . . . ?tongue

I trip for your poem poem.
I like am pass suya & isi ewu!
Why your small Sista when we go be Vals?
A beg, use me as a stand by generator in case your powe holding hold the power!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 5:28pm On Feb 13, 2009
grin angry

No need for generator lai lai
my own na solar power!! cheesy

no more fine sista for u again
u no rhyme well at all 2day!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 5:50pm On Feb 13, 2009
maedan:


grin angry

No need for generator lai lai
my own na solar power!! cheesy

no more fine sista for u again
u no rhyme well at all 2day!!


lol grin grin grin grin

omoge , fine sista,
go easy on d brother,
no b everytime he go fit rhyme tight,
no even rhyme right,
d tin no easy like that,
abi, u get 9 lives like cat?
give am ur sista,
and she go love no other,
everybody deserves a 2nd chance,
d guy can't afford to not eat dat yam

grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:15pm On Feb 13, 2009
maedan:


grin angry

No need for generator lai lai
my own na solar power!! cheesy

no more fine sista for u again
u no rhyme well at all 2day!!

How you come say you no need a generator?
When some men love dey quench like terminator.
At noon the love go over-load with solar power,
But for night, e go blackout like NEPA power.
Your fine sista I for true true like to take,
But now her hand I must try to forsake.
Bride price high well well for Auchi,
Make I manage Aisha wey dey Bauchi!
You fit apply,
And I go reply.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:19pm On Feb 13, 2009
olulu:


lol grin grin grin grin

omoge , fine sista,
go easy on d brother,
no b everytime he go fit rhyme tight,
no even rhyme right,
d tin no easy like that,
abi, u get 9 lives like cat?
give am ur sista,
and she go love no other,
everybody deserves a 2nd chance,
d guy can't afford to not eat dat yam

grin grin grin
Thanks o jare. Man know man. I go dey rhyme all the time? I be Wole Soyinka or Achebe?
For your defence and effort, I go dash that her fine sista. Ebi like say you sabi eat yam.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 6:28pm On Feb 13, 2009
rotimy:

How you come say you no need a generator?
When some men love dey quench like terminator.
At noon the love go over-load with solar power,
But for night, e go blackout like NEPA power.
Your fine sista I for true true like to take,
But now her hand I must try to forsake.
Bride price high well well for Auchi,
Make I manage Aisha wey dey Bauchi!
You fit apply,
And I go reply.

ehen, na now u dey talk beta
u sure say ur lv na all weatha?
anyway, na ur scope i like
u sef, u no fit know psyche?
i dey play na, how i go give u my precious sista
u fit be one serious playa mister!!! grin

olulu:


lol grin grin grin grin

omoge , fine sista,
go easy on d brother,
no b everytime he go fit rhyme tight,
no even rhyme right,
d tin no easy like that,
abi, u get 9 lives like cat?
give am ur sista,
and she go love no other,
everybody deserves a 2nd chance,
d guy can't afford to not eat dat yam

grin grin grin

na my sister u dey call "yam?"
bros, make u stop am!! grin
luv is more than dat
no be game of mouse n cat!! cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:49pm On Feb 14, 2009
maedan:

ehen, na now u dey talk beta
u sure say ur lv na all weatha?
anyway, na ur scope i like
u sef, u no fit know psyche?
i dey play na, how i go give u my precious sista
u fit be one serious playa mister!!! grin
cheesy
I must tell you say I no be playa
I just dey Church dey holla my prayer.
I dey ask Baba make E butter my tea
And bless me always in land,air and sea.
For true,I go prefer you to your little sista,
Make two adults tango go dey better.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:02pm On Feb 14, 2009
lolxxx

u be longthroat no be small
u no wan hear word at all at all
how i go fall 4 brand new toaster
no be say u be d main kokomaster cheesy

i tiff ur poem give my boo, no vex
i also send am to all mypals by text
hope say e no get copyright
bc dat 1st poem dey v. tight . . . grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 8:31am On Feb 16, 2009
maedan:

lolxxx

u be longthroat no be small
u no wan hear word at all at all
how i go fall 4 brand new toaster
no be say u be d main kokomaster cheesy

i tiff ur poem give my boo, no vex
i also send am to all mypals by text
hope say e no get copyright
bc dat 1st poem dey v. tight . . . grin

since d guy flow tight
and rhyme right,
u come trip
and u let ur guard slip
kuku enter d place,
run d race
make we see fit u no go carry belly two,
but, hope would not make u after two ? grin grin grin

rotimy:

Thanks o jare. Man know man. I go dey rhyme all the time? I be Wole Soyinka or Achebe?
For your defence and effort, I go dash that her fine sista. Ebi like say you sabi eat yam.

i've got ur back
u will feel no lack


maedan:

ehen, na now u dey talk beta
u sure say ur lv na all weatha?
anyway, na ur scope i like
u sef, u no fit know psyche?
i dey play na, how i go give u my precious sista
u fit be one serious playa mister!!! grin

na my sister u dey call "yam?"
bros, make u stop am!! grin
luv is more than dat
no be game of mouse n cat!! cheesy

i no call ur sista yam
so keep calm
but tell me, is she really dat fine?
abi u just cook up dat line?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:58pm On Feb 16, 2009
maedan:

lolxxx

u be longthroat no be small
u no wan hear word at all at all
how i go fall 4 brand new toaster
no be say u be d main kokomaster cheesy

i tiff ur poem give my boo, no vex
i also send am to all mypals by text
hope say e no get copyright
bc dat 1st poem dey v. tight . . . grin

Walai talai, I no get am for big longthroat,
Only say I dey over-honest as if I swear oath.
I no be kokomaster but correct lover- master,
And I day stick to friends like I be plaster.
I no vex you send my poem without copyright,
Don't forget say love dey like onions at 1st bite,
E go make you sneeze or cry,
But with me, we go just fly!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:13am On Feb 17, 2009
@ rotimy smiley

my guy dis is getting curious
i no believe say u dey serious
valentine don go since now
its high tym we take a bow
but since u say u be gud friend
make we stick dat way till d end. . . . cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:28am On Feb 17, 2009
@ olulu  angry

  na true i talk from day one
  my sis dey fine n bright like sun
  e be like say u like 2yab
  but me too get quick upper jab
  anyway i no wan fight
  u sef u dey rhyme tight 
  (even tho' u get serious bad mouth . . . grin)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 8:32am On Feb 17, 2009
maedan:

@ olulu angry

na true i talk from day one
my sis dey fine n bright like sun
e be like say u like 2yab
but me too get quick upper jab
anyway i no wan fight
u sef u dey rhyme tight
(even tho' u get serious bad mouth . . . grin)




i no fit fight woman,
afterall, u dey in dis world to serve man,
u think i like to yab?
and u can shut me up with ur jab?
hey, go easy,
don't lets get messy.
u even say i get bad mouth
well, by dis end of month
na dat same mouth
u go dey kiss on top couch grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:08pm On Feb 17, 2009
maedan:


@ rotimy smiley

my guy dis is getting curious
i no believe say u dey serious
valentine don go since now
its high tym we take a bow
but since u say u be gud friend
make we stick dat way till d end. . . . cheesy

Who come dey talk say Valentine don pass?
Every day na for true lovers wey get class.
I no be Police or soja wey go take a bow
My love dey plenty like[b] fura[/b]for Fulani cow.
My heart dey jolly as U say we go be good friends till end,
But I dey fear say like Naija babes ur word go soon bend.
Asssure me you no go try break my heart,
Na only then I go truly throw in my hat.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:26pm On Feb 17, 2009
olulu:


i no fit fight woman,
afterall, u dey in dis world to serve man,
u think i like to yab?
and u can shut me up with ur jab?
hey, go easy,
don't lets get messy.
u even say i get bad mouth
well, by dis end of month
na dat same mouth
u go dey kiss on top couch
grin


OLULU
OLULU
OLULU
How many times I call you name?
True true I no sabi your game!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:29pm On Feb 17, 2009
@ rotimy


i know say u be beta person
wey we fit trust for any season
even if na e-love, nothing spoil
at least e good to ease d toil
na true say whether na valentine or wintertime
correct couples need to flow n rhyme
so make we jolly dey go
with this our pidjin love show . . . kiss
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 10:39pm On Feb 17, 2009
@olulu

see me see palaver
i think say u come enter as observer
i even manage to swallow ur yabs
i come dey hail u for your vocabs
now u don show ur true colour
kiss 4 couch ni, kiss 4 couch ko. cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 9:45am On Feb 18, 2009
maedan:


@olulu

see me see palaver
i think say u come enter as observer
i even manage to swallow ur yabs
i come dey hail u for your vocabs
now u don show ur true colour
kiss 4 couch ni, kiss 4 couch ko. cheesy


well,
if i kiss u, u suppose happy,
u think say na like kiss of those small boys still wearing nappy?
i only wanted to help ur condition, tongue
b4 u enter frustration.
but no yawa,
as u don talk like a typical mama tawa,
i withdraw my offer,
but no come beg me after
grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 9:49am On Feb 18, 2009
rotimy:

OLULU
OLULU
OLULU
How many times I call you name?
True true I no sabi your game!!



coolu temper,
i no dey tamper,
olulu na my name,
being a playa na d game,
but i no dey collect ur woman,
after all, for dis forum u b d main man
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:23am On Feb 18, 2009
chei, for nairaland i don suffer
dis bros O wan make i run 4 cover
i come for peace, na him start war
dis forum of love e don make am curve
bend go a wrong slide
well, we go meet for d dark side
u think say u be player
wen u only sound like hater grin
dis valen-wetin no dey 4 u rara
as u come call me mama tawa

i talk am say ur mouth no good
look as u dey yarn like boy from 'hood
na u gangan get d frustration
i don make u lose concentration
if u beg well well i fit pity u
turn u into my next mumu
but as u no get taste,
my time i no go waste
just leave me and my rotimy matter cheesy
b4 my luv-stylee make ur head scatter
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by sIceees(f): 11:31am On Feb 18, 2009
DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:28pm On Feb 18, 2009
$Iceee$:

DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt


nice 2 c another ryhming sista
dnt mind the Olulu mista
turnin' me to a fighter
when i'm truly a peacemaker! grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:37pm On Feb 18, 2009
maedan:

@ rotimy


i know say u be beta person
wey we fit trust for any season
even if na e-love, nothing spoil
at least e good to ease d toil
na true say whether na valentine or wintertime
correct couples need to flow n rhyme
so make we jolly dey go
with this our pidjin love show . . . kiss

One fine female singer wey get big bobby,
Talk say love wey be true no be for puppy.
She say love dey flow and float like butterfly,
Which mean say na patience one go apply.
Weather e-love,v-love or even sef 365-love,
I go tanda like rock and dey gentle like dove.
E dey do me for heart say you go dey always talk true,
Dat's why I wan flow and see this love show through!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 12:47pm On Feb 18, 2009
$Iceee$:

DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt

Eninem no rhyme pass our own Tuface,
Naija get talents wey dey set de pace!!
You talk say your username na Iceee,
If u be rapper or rhymer we go soon seee.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by olulu(m): 12:51pm On Feb 18, 2009
maedan:


chei, for nairaland i don suffer
dis bros O wan make i run 4 cover
i come for peace, na him start war
dis forum of love e don make am curve
bend go a wrong slide
well, we go meet for d dark side
u think say u be player
wen u only sound like hater grin
dis valen-wetin no dey 4 u rara
as u come call me mama tawa

i talk am say ur mouth no good
look as u dey yarn like boy from 'hood
na u gangan get d frustration
i don make u lose concentration
if u beg well well i fit pity u
turn u into my next mumu
but as u no get taste,
my time i no go waste
just leave me and my rotimy matter cheesy
b4 my luv-stylee make ur head scatter




pity me?
when na u dey beg to b with me.
i b d original player,
and i know say u go like b my bed partner,
i for help ur matter,
and do u well well for ur under,
but u fit go mess up my quarters
since u still b bed wetter.
and ur kind sister,
no sabi love matters,
na when u c money,
u go come try b d person honey.
so go away with ur wahala,
but i vex cause kasala. grin grin grin


$Iceee$:

DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt


i feel u girlfriend


maedan:

nice 2 c another ryhming sista
dnt mind the Olulu mista
turnin' me to a fighter
when i'm truly a peacemaker! grin

lol
oya i no fight again,
since my love u no fit gain,
and if i don cause u pain,
no seek me to slain,
so go deal with ur love matters,
but abeg, no do love for corner corner
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Moyola(f): 12:54pm On Feb 18, 2009
hehe! weldun yu lot! cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:09pm On Feb 18, 2009
Moyola:

hehe! weldun yu lot! cheesy
Ah, thank you Moyola!!
Here we no get wahala
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:09pm On Feb 19, 2009
rotimy:

Ah, thank you Moyola!!
Here we no get wahala

yes o, true true wahala we no get
na only one troublemaker make us forget
d real purpose of this sweet thread
but devil is a liar, 'im go regret
d day e try disturb true vals cheesy
who don dey turn into real pals
so rotimy, how u dey
hope u still tanda as u say
abi d love don dry embarassed
or u wan make i cry
well, friend in need na friend indeed
remember say u don plant d seed
make u no slack make e turn to weed . . .  grin

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)

Oyeku:story Of Lust,injustice, Destiny And Human Wickedness, 18+ / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him / Nephilim

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 79
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.