Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,039 members, 7,828,656 topics. Date: Wednesday, 15 May 2024 at 12:35 PM

Nigeria has finished me!! - Politics (7) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Nigeria has finished me!! (190951 Views)

[Classified Video, MUST WATCH]: NNAMDI KANU HAS FINISHED NIGERIA!!! / Nigeria Has Finished Me: Lessons Learnt / Nigeia Has Finished Me Rejoinder (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (117) (Reply) (Go Down)

Re: Nigeria has finished me!! by harrysjones(m): 8:41pm On Jul 07, 2016
may GOD HELP US IN NIGERIA u wount believe i just dey eat since morning lol
DDeliverer:


lol , I no know o...na foxyflows suppose know..
Re: Nigeria has finished me!! by raziboi(m): 8:42pm On Jul 07, 2016
Ah go follow una reason oooo


The country don tire me...useless men go de shout pdp ..apc ..apga..thurder fire the pioneers of this poli- thief parties

School don even tire me ....on how kwanu guy man go finish school no see work ...
BABA ABEG ANY HOW ....bless all my frnds enemies ....chai

6 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:45pm On Jul 07, 2016
Following cheesy where was this thread yesterday when I needed it...

I dey come make I go charge my phone grin

11 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by mira4u: 8:47pm On Jul 07, 2016
grin grin see vexing
Re: Nigeria has finished me!! by M4gunners: 8:50pm On Jul 07, 2016
DDeliverer:
Person go finish school, after the struggle to go night class everyday, spend better money for seminar and project..struggle graduate with 2.1....spend one long year dey serve him country....yet he no go see job after everything..na this kind life person suppose to dey live?

Some of us don even vex do MSC join...yet no level...
E come be like say we just dey fool ourselves for this country..
some mumu go come here dey shout PDP and APC yet money no dey enter their pocket..them just dey here dey form political analyst..no level..

All the better jobs wey dey this country na for big men children.. if your papa no get money, the chance of you being anything/anybody eventually slim pass broom..

Which kind life be this??
Since when graduates start to speak broken English again for naija?Abeg i no wo laugh ooh.
Re: Nigeria has finished me!! by Klare(f): 8:50pm On Jul 07, 2016
DDeliverer:
I no know where to start from...Everything about this country and her people don tire me..

Caveat: I be the igwe of this thread..if you no know wetin to talk, carry your wahala dey go, make I no change am for you..

For the past two days I never use eye see light...This country suppose be giant of Africa, yet her people dey like slaves...No light to iron clothes, no light to charge phone, no light to do anything for this country... At least if light dey, I go watch TV, I go the chat with phone, connect with people so as to forget my plenty sorrows....but no, them no go gree do anything..I still never know why!!!
Re: Nigeria has finished me!! by Alfred234(m): 8:50pm On Jul 07, 2016
Just 2days na him dey vex you? For my side no light since 3weeks.. You never see anything you just dey start grin

5 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by eddyj36(m): 8:50pm On Jul 07, 2016
Boys seriously need to revolt for this country.. Na same trick wey the so called elite- class play our papa naim dem dey play us again.. Youths need to take a stand now!! #WeWantToBeLeadersOfToday #NoToDarkness #ItMustBetterToday #EnoughIsEnough.. Boys need to enter street to effect the needed change APC this PDP that all of dem na same na their pocket dey raise at the end of the day poor for street no get nothing for pocket... Enough is Enough!!..

12 Likes 1 Share

Re: Nigeria has finished me!! by Klare(f): 8:50pm On Jul 07, 2016
Re: Nigeria has finished me!! by Mhizdiva(f): 8:51pm On Jul 07, 2016
cromz:
Hmmmm, I can see the youths voicing out their anger. What u don't know is that the situation you are complaining about someone is praying to be there. At least u still HV Money to buy mb comment for nairaland. No matter ur situation or victim of what u have become a hero lies in you. U can't just sit ur lazy ass down and comment on nairaland about ur plight. The difference between u and those in power is their ability to think outside the box and do something for their selves.
Whenever situations like this arise a hero is needed. U can lead a protest, write about the situation. There are so many ways u can be a revolutionary. And make a name for yourself. Am advising u to do something about your current situation and help others around u too. Finally am ready to help any two youths with 5k cash each the money will be deposited in ur accounts next week so that I can assist too.
..........
Re: Nigeria has finished me!! by Klare(f): 8:51pm On Jul 07, 2016
This country is heading to lipsrsealed
Re: Nigeria has finished me!! by banmee(m): 8:52pm On Jul 07, 2016
DDeliverer:
I no know where to start from...Everything about this country and her people don tire me..

Caveat: I be the igwe of this thread..if you no know wetin to talk, carry your wahala dey go, make I no change am for you..

For the past two days I never use eye see light...This country suppose be giant of Africa, yet her people dey like slaves...No light to iron clothes, no light to charge phone, no light to do anything for this country... At least if light dey, I go watch TV, I go the chat with phone, connect with people so as to forget my plenty sorrows....but no, them no go gree do anything..I still never know why!!!

Bros, take this as constructive criticism. Na your fault. Na my fault. Na every single person for Nigeria fault. The country no just spoil like this from nowhere na. Every leader wey naija don get from day one, dem born dem for here. Dem no be Togolese. Dem be Nigerians. E mean say dem grow up for here and don de used to the kotokoto way of doing tins, so when dem become leader, na kotokoto leadership dem de give una. Even if you, wey de complain, become President or Governor you go do the same thing or worse. Why? Because Nigerians no know the standard. And if you no know the standard you no fit implement the standard. See fayose for ekiti wey dem say e tif plenty money. For normal country, e go resign jejeli so as to clear im name and make sure say e no affect governance for im state. Meanwhile, bros wan die for there and the worst tin be say plenty Nigerians, wey de suffer, de support am. How dat one take make sense? If i no know better, i for talk say Nigerians generally mumu but i go say make you decide for yoursef.

https://www.nairaland.com/3212392/fayose-takes-walk-street-after#47303462

5 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Klare(f): 8:52pm On Jul 07, 2016
jking001:
Thoughts of a reasonable person,common sense is not common you go make am but e go take time.

shocked
Re: Nigeria has finished me!! by Klare(f): 8:53pm On Jul 07, 2016
Klare:
This country is heading to lipsrsealed
Re: Nigeria has finished me!! by johnstar(m): 8:54pm On Jul 07, 2016
DDeliverer:


lol , I no know o...na foxyflows suppose know..
dat guy self juz put person for is coming undecided

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by Klare(f): 8:54pm On Jul 07, 2016
M4gunners:
Since when graduates start to speak broken English again for naija?Abeg i no wo laugh ooh.

Makenwe laughter together.
Re: Nigeria has finished me!! by annnikky(f): 8:55pm On Jul 07, 2016
9jeria jaga jaga, everything scatter scatter poor man dey suffer suffer........

D silly bubu is there fighting silly corruption while d poor masses r suffering n smiling at d same tym. I dnt blame him cos naira, dollar, pounds is in his bank acct so he doesn't know wat d poor masses r going tru..

Oluwa abeg pick our calls cos we tire for this we country call giant of Africa undecided

8 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by ouigy99(m): 8:55pm On Jul 07, 2016
DDeliverer:
Person go finish school, after the struggle to go night class everyday, spend better money for seminar and project..struggle graduate with 2.1....spend one long year dey serve him country....yet he no go see job after everything..na this kind life person suppose to dey live?

Some of us don even vex do MSC join...yet no level...
E come be like say we just dey fool ourselves for this country..
some mumu go come here dey shout PDP and APC yet money no dey enter their pocket..them just dey here dey form political analyst..no level..

All the better jobs wey dey this country na for big men children.. if your papa no get money, the chance of you being anything/anybody eventually slim pass broom..

Which kind life be this??

OP, with this your lamentation, I for say make you go church for dileverance as e be like say them follow you from village.
But when you go church, the pastor wey get 3 private jets, countless cars and houses go still tell you "you must sacrifise something". First fruit, tithe, vat, tax, new month offering, first son dues, till them collect all the money wey you save from NYSC
The painful part be say you ar more likely to be " blessed" with riches playing baba ijebu or bet9ja than for the scamming pastors prayer to wok for you.
By the time you dey go house and you enter bus wey be one chance.....by the time them search you no see money.....carry you go ATM and na 200 naira dey your account....your own don be

14 Likes 2 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by francizy(m): 8:58pm On Jul 07, 2016
Best thread of the year!! At least people still get sense for this country!! cool

19 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:58pm On Jul 07, 2016
Oyimeoyimemua:
its rather unfortunate that d youth of this country are at d receiving end .the gap between the rich and d poor is getting wider,i just pray it won't get to a point where some people will be stoned
it has to get that point. A few people think they own the country.
Re: Nigeria has finished me!! by teeghurl(f): 8:59pm On Jul 07, 2016
Nigeria need a total revolution. Until we get to that stage where Nigerians can hold their leaders accountable not minding how, not showing mercy at all. These leaders will always take us for fools. Sorry i forgot 90% of the youths who can do this r cowards and lily-livered, gullible people. We can only shout on internet but shut our mouth with a small change in the pockets. Imagine a councillor sharing rice in a small borough in England just to gain votes, people will look at him and ask if he's mad. Infact, that will even make him lose the election but come to my country, they will even stampede each other. Indeed, mental slavery is the worst of all. O ma se o

22 Likes 2 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by danwilliams4u(m): 9:00pm On Jul 07, 2016
Naija self don tire me
Re: Nigeria has finished me!! by kayusre: 9:01pm On Jul 07, 2016
seriously...i just de laff like mumu...
DDeliverer:
hahaha..chaii.

these guys too funny o
Re: Nigeria has finished me!! by Blessedward: 9:03pm On Jul 07, 2016
laff don carry me throway for dis thread...see talents wasting here...SERIOUS COMEDY SERIES on d run here..tho they are simply d reality in this country but guys am enjoyin d comedy part of d thread

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by sixtus3606(m): 9:03pm On Jul 07, 2016
DDeliverer:
I no know where to start from...Everything about this country and her people don tire me..

Caveat: I be the igwe of this thread..if you no know wetin to talk, carry your wahala dey go, make I no change am for you..

For the past two days I never use eye see light...This country suppose be giant of Africa, yet her people dey like slaves...No light to iron clothes, no light to charge phone, no light to do anything for this country... At least if light dey, I go watch TV, I go the chat with phone, connect with people so as to forget my plenty sorrows....but no, them no go gree do anything..I still never know why!!!
Just 2 days and you don dey complain? undecided
Its been over a month since we've experienced electricity here in omole

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 9:03pm On Jul 07, 2016
banmee:


Bros, take this as constructive criticism. Na your fault. Na my fault. Na every single person for Nigeria fault. The country no just spoil like this from nowhere na. Every leader wey naija don get from day one, dem born dem for here. Dem no be Togolese. Dem be Nigerians. E mean say dem grow up for here and don de used to the kotokoto way of doing tins, so when dem become leader, na kotokoto leadership dem de give una. Even if you, wey de complain, become President or Governor you go do the same thing or worse. Why? Because Nigerians no know the standard. And if you no know the standard you no fit implement the standard. See fayose for ekiti wey dem say e tif plenty money. For normal country, e go resign jejeli so as to clear im name and make sure say e no affect governance for im state. Meanwhile, bros wan die for there and the worst tin be say plenty Nigerians, wey de suffer, de support am. How dat one take make sense? If i no know better, i for talk say Nigerian generally mumu but i go say make you decide for yoursef.

https://www.nairaland.com/3212392/fayose-takes-walk-street-after#47303462
pls stop saying this @ bolded. There are so many Nigerians willing to do things differently. If 80 percent of politicians do not see government as a means of livelihood, Nigeria won't be where it is.

3 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Ymodulus: 9:05pm On Jul 07, 2016
cromz:
Hmmmm,
.....


..
Finally am ready to help any two youths with 5k cash each the money will be deposited in ur accounts next week so that I can assist too.

I will join your good gesture. Am ready to help 4 youths with 5k Each.

20 Likes 4 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 9:07pm On Jul 07, 2016
Teespice:


and if that happens, your kind will call me a liability and a gold digger.

last time I checked, nobody wants to be attached to a liability.

your line of reasoning sef leaves so much to be desired.

Na grammar u dey yarn, boys never chop u dey leave much to be desired.

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by Ymodulus: 9:07pm On Jul 07, 2016
Obas101:
Op do not let yourself be victimized. If the system is not helping you, do the best you can for yourself. Inshallah it will be well with you.
I think i need to open a thread about moving beyond a victim mentality.. Will quote u wen i do wink
qoute me when you open the thread. I do have some inputs; that is if you don't mind

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by izzou(m): 9:08pm On Jul 07, 2016
Ask this man for the light

7 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by niggi4life(m): 9:09pm On Jul 07, 2016
MaziOmenuko:
Ee come be like say everything for this country dey harsh, mosquitoes come harsh pass. No insecticide dey kill them again, abi dem don mutate come develope resistance for insecticide. I don spray tire, pour snipper sotey na me the snipper wan come kill. To breathe na wahala, still mosquitoes dey bite, sulk and even chew.

The other day I no sabi as rat take run enter my kitchen. I no even border myself to look for am. I just secure my certificate them because I know say if hunger finish with am for that my kitchen, the next thing him go do na to dey find my certificate. This morning, na so I see the rat lie down for my kitchen. I been think say him don die until I notice say him dey breath small small and dey blink him eyes. I just use broom sweep the thing comot.

The huzzling is real!
hahahahahahahahahahahahahahahahahaha grin grin grin grin cheiiii, my belle dey pain me oooo, i don too laff oo grin

1 Like 1 Share

Re: Nigeria has finished me!! by sunnyside16(m): 9:09pm On Jul 07, 2016
Our sins being crave for change

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (117) (Reply)

The Remaining States That Will Decide The Winner Of The Presidential Election / Nigerian Defence Academy (NDA) military training (pics) / Abba Kyari Is Dead!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 63
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.