Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,157,586 members, 7,833,898 topics. Date: Monday, 20 May 2024 at 09:17 AM

Story Unknown - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Story Unknown (239 Views)

Unknown Destination (The Hellish Life At The Orphanage) / Unknown Killer / Unknown Enemy - A Romance Story (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Story Unknown by Lucrativress(f): 11:59am On May 16, 2022
Chapter 1



Guy how far, I heard what you said to Chenye.
Nigga you Sabi lie ooo.

Alaye dem no go cut your game o, Segun no con spoil my parol o.(Femi retorted)

Ah Odogwuu! I hail you, na you be the real Ladies man, se na so all these girls dey find love so
How person go tell me say when he was 8 years old he had this girl in his Class named Chenye that their Elemi for Church talk say she get similarities with his future Wife and me too I go believe.
Ahhh Femi o bad gaannn, your toasting game na first Class upper.
Hope no be say you wan clean chop mouth with this Girl? Femi o wrong now, this Babe wey I dey see no deserve am.
She dey even seem like tear rubber, Femi ma lo gba epe ooo.(don't collect curse o)

Segun se you wan con dey whine me ni, wetin concern you with my life na abi you done dey eye her ni?
Mo Fe ma jese omolomo onso katakata ( I want to be eating her work you're saying rubbish), I no even know say you get spiritual eyes, how you know say she never dobole before?

Femi you're too raw, ewo ni dobole nsi, I no just understand wetin good girls dey see for your body, Lai sepe you dey use jazz, make I be ugly girl sef ,I no fit fall for badz guy like you.

Segun see make I clear you, you see that Chenye girl wey you dey see ehn, her type dey my phone well well, dem just dey wait for the Angel wey go tear them, the person wey get the mind to taste the forbidden fruit with them, dem dey wait for the Satan wey go sweet talk them, no be say dem no want am, na just small persuasion dem dey find, Nigga make I teach you A games, me be confirm Courtier, na amutorunwa my talent come.

Femi you sure say you wan born girl?
And you no go fear?
Ahh!!
I sure say na Lucifer go come down come toast your Daughter.

Wa alaye se wo sepe fun e sa ( come bros,hope they did not swear for you), why you con dey curse me na. Which kin nonsense be this one na,why you go dey swear for my unborn kid's, if na play stop am o. No dey play that kin play with me o, so ya weyrey ni (are you insane), I no like am oo.

Femi you dey spoil all these girls life, you no go marry her, you wan cut her ribbon, the day wey you go jam ogbanje, e go turn horror movie for your eye.

2 Likes

(1) (Reply)

Help On How To Complete My Site / Afloat / Don't Give Up

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.