Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,252 members, 7,829,476 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 07:44 AM

NÀÌJÁ POETRY 45: Kwarapshen - Education - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Education / NÀÌJÁ POETRY 45: Kwarapshen (250 Views)

NÀÌJÁ THROWBACK: The Asaba – Onitsha Crossing, 1959 & Now / NÀÌJÁ POETRY 44: I Will Find You / NÀÌJÁ POETRY 42: Makoko (2) (3) (4)

(1) (Reply)

NÀÌJÁ POETRY 45: Kwarapshen by NaijaphiliaBlog: 5:26pm On May 02, 2023
KWARAPSHEN – “Corruption“
(A poem in Pidgin English)

Me, ma na SARS
I sabi drop bars
My gun ready to blast
Any youth wey dey drive cars
If tattoos na your singlet
We go treat you like piglet
If you no gree cooperate
Omo, you go catch bullet.

Me ma na politician
If you check, I be magician
I dey “pight” my brand of “kwarapshen”
Play ball, I go give you admission.
My certificate na banza
My account balance na fire
If I like I go make yanga
Even next time I go still dey power.

Me ma na Naija
Our mumu don end here
Una plans go backfire
Na my generation go matter
Una vision dey our museum
And we ready to change our condition
Even if una kill small portion
We go still carry out our mission.

Lekki na the catalyst
We go use am minimize fatalities
We don learn all una tactics
And we have all the relevant statistics
Baba God na our confidence
Next election una go see our relevance
We dey ready- no more reluctance
2023 una go see proper sense.

AUTHOR: Kelechi Timothy Francis, born in Nigeria, West Africa.



SOURCE
https://naijaphilia.com/blog/2023/05/02/naija-poetry-45-kwarapshen/

1 Like

(1) (Reply)

Urgent Assistance for me to take a decision over the college to pay for / 18 June HNBUMU B.sc Nursing Answer Key 2023 Uttarakhand Medical Entrance Test / Ayodeji Arojo Rewards Lasu's Best Graduating Student

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.